One lady wey bin dey work for one bank for Ghana as national service staff don dey sentenced to forty five days imprisonment.
Di High court bin sentence Deborah Seyram Adablah afta dem find say she “attack di judge” wey dey sit on top one case she file against di finance officer of di bank ova “breach of promise and sexual harassment.”
Seyram bin sue di pesin she describe as her ‘sugar daddy’ oga Ernest Kwasi Nimako say e fail to fulfil di promise e make to her.
According to Seyram, di man wey be di finance officer of di bank at di time, promise to take care of her.
She also tok for di court documents say her ‘sugar daddy’ bin promise to give her moni as capital for business, rent for three years, one car, monthly allowance and moni for medical bills.
But di man no gree do these tins afta dia relationship scata.
Sake of dat, Seyram tok say she no go return di car wey di man don give am as dem kontinu dia battle for court.
On 16 May 2023, di high court order say make Seyram hand over di car wey e dey fight ova wit her ‘sugar-daddy’ to di court registrar.
Justice Olivia Obeng Owusu wey give di order tok say make she submit di car to di court until dem go finish di case proper.
Wetin happun for court
As part of di ruling, di court also order di finance officer, wey also be deacon for church, oga Ernest Nimako say make e submit di car documents to di court registrar.
Di court also order say make di plaintiff stop to dey comment on di mata on top social media.
For July 2023, di court bin strike out di name of di bank from di case afta dia lawyers file one motion .
Di court also award Ghc 6,000 cost against Seyram say she mention di name of di bank for di case wey involve one of dia officers.
But on 28 November 2023, di court wey justice John Bosco Nabarese bin dey preside dismiss di main case against di bank officer.
Di court tok say even though di relationship between Seyram and di bank finance officer na “immoral wey dey against society, di writ no get reasonably cause of action.”
Di court add say “di foundation of di relationship no be sometin wey di court gatz to give judicial stamp.”
“You no fit to recover di price of sometin you don commit for immoral act.”
Na so di court award Ghc 10,000 against Seyram Adablah at dat time.
For March 2024, di criminal investigation department of di police (CID) bin submit report to di court say di plaintiff (Seyram) bin assault dia officers di time dem go her house to enforce di order to collect di car.
Police detective Sergeant Thomson Ayitey tok say “Seyram bin obstruct police from dia work and she assault dem”.
Seyram and her lawyers on 15 June 2023, also file appeal against di order.
For February 2024, lawyers for di bank officer file application for di high court dey seek “summary judgement.”
Dem tok say even though di court don dismiss di main case against dia client, dem show di court say di plaintiff, Seyram Adablah no get chance to succeed for any case for dis mata.
At dat time, na two motions dey bifor di court, one na contempt application di lawyer of di banker file against im former lover on 6 June 2023.
Di oda one na application weySeyram Adablah file to set aside di order wey tok say make she submit di car to di court; dem file dis one on 15 June 2023.
Why di court find her guilty of contempt
As di case kontinu to drag, Deborah Seyram Adablah wey become popular on top social media bin dey use her TikTok account to do plenty videos wia she dey comment about di case.
Inside one of di latest videos wey dem present for di court, Seyram tok say di judge wey dey sit on top di mata dey bias.
Inside dat video, she tok say wetin di bailiffs wey collect di car from her do na wrong tin.
She allegedly attack di justiciary, she tok say if you get case for court and you no get power, you no fit get justice and oda tins.
She also accuse di judge, Justice John Bosco of “favouritism and unprofessional conduct.”
Inside di video dem play for di court, she warn di judge to dey “fair for im rulings or e go face her anger.”
“Be ready to dance to dis drum you dey beat, you no fit to sit dia and chop salary for our sweat and still dey side-line me,” she tok for di TikTok video.
Na so di court issue bench warrant say make dem arrest her.
Inside anoda video for her TikTok page, Seyram tok say she see say di court issue warrant say make dem come arrest am, na so she go hand herserf ova to di court.
She tok for dat video say “di contempt case na dead on arrival. I dey advise, make you no go court if you get case, I know di system.”
Di court find her guilty of contempt and di judge sentence her to 45 days for di Nsawam prison.
Inside anoda TikTok live video she do afta di court sentence her, Seyram tok say dem dey prepare to carry her go prison.
“Na di same judge wey throway my first case, na im jail me 45 days, na normal tin. I go surely come back afta di 45 days.”
She add say “I go inform una everitin wey go happun bifor I enta di prison.”
She tok her followers say make dem no worry about her she go dey fine.
Di court jail Seyram for 45 days sake of im dey guilty of contempt of court afta im fire di judge on top her case for tiktok
Source: BBC